A
social media user has shared photos and the shocking story of a woman
who dumped her baby girl by the roadside after her Church Pastor
allegedly told her that her baby is a snake.
The woman and her daughter (left) & the church pastor' poster (right)
Below is how a Facebook user identifed as Sapele Oghenek who posted the photos on social media, narrated the story online;
SAPELE DELTA STATE MUST BETTER. - 03/04/2017.
WHO TO BLAME?
If I talk about men of God, some persons here go carry cutlass for my neck, like say na all men of God,nai God call.
Make I nack unu this very short story make only unu tell me who dey
wrong before I go use am do post by 3pm about wetin I think about this
people wey involve.
We all know say na women nai go Church pass and na dem nai still
dominate marine world and coven. Where problem nor dey, only some women
go use deir legs go find trouble put, after them go dey catch witch.
Yesterday early morning at about 4:30am for "Green Egbedi by
Reclamation road", nai dem see one baby for d junction dey cry
seriously.
As God go do am, dem cum carry the pikin go Police Station, go register the case and make complain.
Na later in the day, dem cum see d mother of the baby, wey cum talk
say, na one pastor wey get Church for cemetery by palace hotel, nai
tell her say, her pikin na snake and make she bring N52,000. So that he
fit pray for the baby and d baby go dey better.
The name of the woman na Amara Emeka and she dey stay macphason by
Komi Rd. Na the Pastor talk, nai put fear for her mind, wey make her go
drop the woman for the junction, so that the baby go cry die or make dem
carry the baby go Madam Buwa easily, becos she nor fit raise the
N52,000 to give her man of God.
Make we all nor look this matter throway face, becos e good make we pour out our mind,for others to learn from.
According to Tafia Keneri, e say some Pastors dey use bottom power
take dey talk with deir members and e dey make the members dey fall
victim to anything dem tell them. Keneri say na charm some Pastors dey
use.
Marian Jasper talk say, she nor believe the woman, say she dey lie
and also talk say, if she nor want the pikin, why she nor throway her
for other places, wey e be say, na where eyes go quick see d baby and na
make dem for pity her, make her go dump d baby there.
We for studio don think this matter pass different angle, nai make we say make we hear unu version.
(NA THE WOMAN PICTURE AND THE PASTOR CHURCH BUILDING AND BANNER DEY ATTACHED TO THE UPDATE.)
No comments:
Post a Comment